A friend of mine let's call her Aminat was on her way to work one morning when she boarded a cab. After a while someone alighted from the cab and went to the boot to get his luggage and after he had left the driver came back in to ask who owned a big ghana must go bag, a fellow sitting next to Aminat claimed it as his and the following conversation ensured between the occupants of the cab, Driver, Bag Owner, Aminat, Igbo guy and Old Woman
Driver: Wetin dey inside your bag?
Bag Owner: Na just clothes and other stuff.
Driver: E no fit be just clothes o, that bag heavy die, police fit stop us wan search so i suppose know
wetin dey inside.
Bag Owner: Oga na money dey inside o, my oga wey dey Kano die and them allow us carry anything wey we want from him house, some people carry car, i no fit drive so i carry that bag of money.
Driver: How much money?
Bag Owner: Like 15,000 dollars, for naira na 480 million.
(mathematics is definitely not his strong suit)
Everyone: What!!!!!
(They can't calculate either it seems)
Driver: See this guy wey wan koba me o, you put that kind money for my booth you no tell me. You go settle all of us for here before you fit go since you put us at risk.
Aminat: i'm already late for work let me get off, you guys can settle yourselves.
Driver: You no fit comot o, you don hear the gist you have to finish it with us, no worry i go carry you go where you dey go.
Bag Owner: No worry i go settle all of una, the problem be say my oga put jazz on-top the money so if you touch am you go fall, na why i carry the entire bag.
Igbo guy: I sabi one pastor for one side, he go spoil the jazz for us.